speEcH ConFeSsioN with
luke
na grammer dey confuse black man . i no mean black man
just like that but the KPAKO ones (like me).No laugh sha
becos u dey too .With the advent of "ajebo children" i no say
na oyibo man imbibe this kind of spirit wey dey make small
small pickin dem dey use cunny insult man like me.
No be im i go one of my parley house .
bob na 1st class aje my guy be but 4 outside
im dey use ajekpako paint picture .i jam im small sister
wey no reach 5 yrs ol. being say na me be big bros
, i wan make de pickin( sory o! child) happy na im i
say hello.no be im talk start . the child dey talk like
penury .and na so so grammer full her sentence.
"uncle?"
"mmmmm?"(i use mmmm becos i dey try avoid saying wetin?)
Do you know what the USA government will do to
Saddam ?"
"i no go fit say that wan."i talkj the sentence
fat make she no fit filter the bad grammer wey me think
contain the sentence.
"Uncllllllllee" See as this child call my name as
if na catch im catch me dey thief for pot .no be im
she continue.
"At your age your English is not still impeccable."
I come start to dey smilegive the pikin becos i
no no the grammer she break.My friend wey carry me show
im bulk come hala for the pikinsay make im apologise.Na latermy
guy decrbe the level of yabis the pikin sama me.(to be contd)
nO vex say wi delay o, na people to sponsor
dis page na im wi dey find.all di bros dem and B
dem make unu no vex.
aS i dey yearn b4 man pickin waka di other time
,lawyers and English na so dem tight.Dem go wan decieve people
wey dem dey interview for inside court.I hear say AAU ,Ekpoma
dey produce the best lawyers . Na im i do my investigationto
try decode how dem dey take merit this grade .The Question wey
dem go ask you go first frustrate you.u no go no how
you go take answer am. b4 u go no anything, dem don
win case.Dis na some of the Questions wey dem dey ask.
*Your twenty one years old son , how old is
he?
*You say the stairs went down the basement,did they
go up also?
*You went to a honeymoon .Yes .The woman you went
with , was she your wife ?
*The accident killed him instantly?Yes .What did the accident
victim say afte the accident?
*Where you present when your picture was taken?
*Mr. John Odumwinyi, what is your name ?
*How was your first marriage terminated?By death. Whose
death,yours or your wife?
Even 4 UNIBEN(Great) wey the president of cyon
Holy trnity finish dey study law ,di law wey dem learn resemble
medcine. nA dis kain question dem deu ask person for court.
*Your health was diagonised by Doctor Kola,is he a
doctor?
*When you wre doing the autopsy was the victim dead?
*I was shot in the arm.Was it below your navel?
Don't you think the patient was still alive at the
time the autopsy was performed ?No his brain was on my desk
jar .
* All your response must be oral ,okay?
What school did you attend?Oral.
*Describe the individual.A medium aged man with moustache.Was
this person a male or a female.
if u read these things u go no say grammer dey
confuse kpako and aje........... alike.